Powered by Blogger.

Monday, 8 August 2016

Naija don qualify enter Olympic quarter final

Naija Dream Team don take style qualify enter the quarter final  – The Dream Team manage hama Sweden 1 kondo for them second game – AS Roma sabi striker Sadiq Umar na hin be the guyman wey score the goal  Better don happen for Naija boys for this year Olympics games wey dey happen for Brazil as the Dream Team don become the first team wey go qualify enter the quarter final. Share on
Facebook Share on Twitter Share on Whatsapp Sadiq Umar in action for Nigeria GET for FREE: Get the latest sports news on Naij Sports Na the 1 kondo wey Siasia pikin dem take hama Sweden for their second game na hin kon helep dem enter the next round and naso everybody kon dey hail them for the better ball wey dem play. Sadiq Umar wey dey tap hin club football for AS Roma hin score the goal wey helep Naija win de match. Make unna no forget say na Naija be the last team wey enter Brazil for this competition, but the Dream Team no send anybody as dem bilala Japan for their first match. Walahi if no be say Naija boys troway plenty chance for this match, the goal wey Dream Team for score for enter 5, but the koko be say dem collect the 3 points wey na hin matter pass. For the second half, Andreas Linde wey be Sweden goalie save dem o as the guy no gree open hin yansh for Mikel and Etebo. As the matter kon be now, Naija don qualify enter the next round, and the Dream Team no go take gragra play their last group match.

0 comments:

Post a Comment